93
Na God Bi King
God na king and en glory wey dey shine well-well,
kover evriwhere.
True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa.
Di world stand gidigba
and nor-tin fit shake am.
My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world.
Yu yorsef, don dey forever and ever.
My Oga God, even doh rivers dey full
and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed.
God get pawa pass all dis tins!
My God! Nobody fit shange yor laws!
Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.