94
Na God Dey Judge Evribody
My Oga wey dey fight for pipol.
Di God wey dey take revensh, make Yu show us yor glory!
Raiz-up make Yu judge di pipol for di world
kon give proud pipol wetin dem deserve.
My God, na wen Yu won take judge wiked pipol?
Na how long wiked pipol go dey celebrate?
How long dem go dey tok anyhow?
Na how long dis wiked pipol go dey make mout?
Oga God, dem dey kill yor pipol
and wound doz wey Yu koll yor own.
Dem dey kill wimen wey dia husband don die,
strenjas and shidren wey nor get papa and mama again.
Dem sey, “God nor dey si us! Israel God
nor even kare about wetin dey happen.”
But una wey bi fool, make una tink again!
Wen una go really get sense to undastand?
Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word?
Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
10 If E fit ponish wiked nashons,
una tink sey E nor go ponish una?
E know evritin, so make una nor tink
sey E nor know wetin una dey do.
11 God know wetin pipol dey tink;
E know sey wetin human being dey tink, dey yuzles!
12 So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy.
Doz wey Yu dey tish yor ways.
13 Yu dey free dem from trobol
and dem go dig pit wey go katch dia enemies.
14 God nor go rijet en pipol;
E nor go leave di pipol wey E love well-well.
15 God good judgement go kom again and doz wey get betta
and klean heart, go dey save.
16 Naw, who go protet mi from wiked pipol?
Who go help mi fight doz wey dey do evil?
17 If to sey God nor kom help mi, I for don die and pipol for don forget mi.
18 But I shaut kon kry sey,
“I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail,
kom support mi.
19 Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort,
give mi new hope and make mi trust Yu.
20 Wiked leaders go fit sey God dey dia side?
Leaders wey dey use di laws take opress pipol!
21 Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite
kon kondemn and kill innocent pipol.
22 But na God bi di place where I hide put;
na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
23 So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins.
True-true, di Oga awa God go distroy dem.