95
Praiz And Woship Song
Kom make wi sing praiz God!
Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us.
As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am.
Make wi sing psalms take praiz am.
Di Oga na great God!
Na great King wey pass evry oda god.
Under di eart dey en hand
and na-im get di mountins too.
Na-im get di sea,
bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too.
Kom! Make wi go woship
and bow to am.
Make wi knee down
before God wey make us,
bikos na-im bi God.
Wi bi en pipol and E dey wosh ova us,
bikos na wi E dey kare for.
God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do
wen dem dey Meribah and Massah
wey dey di wildaness.
Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do,
dem still test and try my patient.
10 So, I vex for dem for forty years kon sey,
‘Dis pipol heart don turn from mi
and dem nor gri do wetin I tell dem.’
11 So I kon swear as I dey vex sey:
‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”