96
Na God Bi Di Great King
Make una sing new song for God!
Make di whole world sing to am!
Make una sing and praiz God name.
Evriday, make una tok about di good news sey,
“E dey save en pipol.”
Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons.
Make una tell evribody about di good-good tins wey E do.
God dey great! Make all praiz bi en own!
E big pass all di oda gods.
Oda nashons god, na just juju dem bi,
but na awa God make di heavens!
Honor and majesty dey round am;
strent and beauti dey en temple.
Make all di nashons for di world know God well;
make dem know sey God strong well-well and E get glory.
Make una give God di glory wey bi en own!
Make una bring una ofrin as una dey enter en temple.
Make una woship God with all en glory and wonders.
Make all di eart shake fall for en front.
10 Make una tell di nashons sey, “Na God dey reign!”
Di world stand gidigba and dem nor go fit shake am.
God go judge evribody akordin to wetin dem do.
11 Make di heavens and di eart dey happy!
Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!
12 Make di field and di plants, shaut for joy!
Make di trees for forest dey make sound with praiz
13 before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart.
E go judge di world well-well
and E go judge evribody akordin to wetin dem do.