97
Na God Bi Di Great Ruler
God na king! Make di eart happy!
Make river and sea happy too.
Dark kloud dey round am.
Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
Fire dey round God for front
and E burn all en enemies for evry side.
En tonda lite dey shine round di eart,
so wen di eart si am, e kon dey shake.
Di mountins dey melt like butter
wen dem si God wey get di whole eart.
Di heavens dey tok about en raitiousness;
evribody dey si en glory.
But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju;
doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin,
bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy,
bikos of how God dey judge pipol!
Yu, God get pawa pass evritin for dis world;
so dem go praiz Yu pass any oda god.
10 Una wey love God, make una hate bad tins!
God dey protet pipol wey dey fear am
kon save dem from wiked pipol pawa.
11 Pipol wey dey fear God,
lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart,
dey always happy.
12 So make evribody wey dey fear God,
happy kon praiz en holy name!