Amos
Introdushon
For di first half for 8th century BC, Israel pipol wey dey for di nort kingdom kon strong well-well (2 Kings 14:23-25). For di forty-one year wey Jeroboam II rule di kingdom, di nashon win many war and di pipol kon woship God, as di pipol bilive God wey word wey sey, “God dey with us!” Dem kon dey wait for di day wen God go distroy all dia enemies and make Israel nashon so strong wey nobody go fit defeat dem again. Amos, wey en family bi sheferds and e grow up dey guide animals for Tekoa, for di sout-side for Judah, kon dey profesai. E go di great royal temple for Bethel, kon tok sey God dey prepare one nashon wey go skata Israel pipol. E sey dat day go dey dark well-well, as lite nor go shine at-all. God nor dey happy with Israel pipol bikos of dia plenty money, military pawa or di way dem dey live dia life. Pipol wey get money and pawa kon dey sofa poor pipol. God tell Israel pipol sey di only way dem nor go sofa for all di bad tins wey dem dey do, na if dem turn from dia sin kom meet Am.
Amazaya, wey bi di high priest for di temple for Bethel, kon akuiz Amos sey e nor loyal and e dey tok nonsense. So dem purshu Amos komot from di kingdom, but dem rikord evritin wey e tok and na some of en words dem first rite down among Hibru profesy. Na about 36 difren message dey di book.
1
Introdushon
Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel. Amos sey,
“God vois bi like lion own from Mount Zion;
en vois for Jerusalem bi like tonda nois.
All di trees and grass wey dey Mount Karmel,
dry finish.”
God sey,
“Damaskus pipol don too sin,
so I go ponish dem naw,
bikos dem flog Gilead pipol
with stik wey get iron tit.
I go send fire kon burn di palis wey King Hazael build.
I go burn King Ben-Hadad strong-strong buildings rish groun.
I go skata Damaskus town gate;
I go remove di ruler from Aven Valley
kon kill di pesin wey whole di royal rod for Bet-Eden.
Dem go katch Aram pipol kon karry dem go Kir land as prisona.”
Dis na wetin God tok.
God sey,
“Gaza pipol don too sin,
but I go ponish dem naw,
bikos dem sell a whole kountry
as slave give Edom pipol.
So I go skata Gaza town with fire
kon burn all di strong-strong buildings
wey dem hide put.
I go kill all di rulers
for Ashdod and Ashkelon town.
I go ponish Ekron town
and Filistia pipol wey remain, go die.”
Oga God wey get pawa don tok.
God sey,
“Tyre pipol don too sin,
but I go ponish dem naw,
bikos dem sell a whole kountry
as slave give Edom pipol
and dem nor gri keep di agriment
wey dem make with Israel.
10 So, I go skata di town
kon burn all dia strong-strong building for der.”
11 God sey,
“Edom pipol don too sin,
so I go ponish dem naw,
bikos dem kill Israel pipol wey bi dia own brodas
and dem nor sorry for dem at-all.
Dem vex kill dem anyhow
and dem nor dey taya.
12 So, I go distroy Teman town
kon burn Bozrah strong-strong buildings.”
13 God sey,
“Ammon pipol don too sin,
but I go ponish dem naw,
bikos dem dey fight to get more land
and wimen wey get belle for Gilead,
dem tear dia belle open.
14 So, I go skata Rabbah town
kon burn all dia strong-strong buildings rish groun.
Wen di war start, pipol go dey shaut
and e go bi like wen heavy breeze
dey blow and strong rain dey fall.
15 Dem go karry dia king and en ofisas
as slave go anoda land.”
Dis na wetin Oga God tok.